Breaking News

Tuesday, 13 October 2015

Come See Am Live As Dem Senators Dey Fire Ministerial Nominees Dem Questions, And Dem Too Dey Ansa

By on 05:29


My fellow country people, una fit dey watch am like say una dey there LIVE for inside National Assembly as Senate dey set exam questions for our ministerial nominees and dem dey answer am.

As I dey talk am so, dem senators, wey na dem dey set the exam questions

Tribunal Go Yarn Us Today Weda Saraki Go Comot For Him Seat For Senate, Abi Him Go Siddon For There Gidigba

By on 02:29


Na today the tribunal wey dey check election wey dem do for National Assembly people dem for Kwara State on March 28, 2015 weda e get mago mago abi dem do abracadabra, go knack us the correct thing wey happen as e take concern oga pata pata for Senate, Dr. Bukola Saraki.

One man wey dem dey call Alhaji Abdulrahman Abdulrasaq

Monday, 12 October 2015

Presido Buhari Don Send New Names Of People Wey Go Become Minister To Senate

By on 11:23


The second batch of people wey go follow oga Presido Muhammadu Buhari work wey dem dey call ministerial nominees, don reach Senate Presido, Bukola Saraki hand. 

The first batch, wey oga presido send go give Saraki for the last day of the month wey we just pass so, been get the names of 21 ogbonge people including the governors wey