Na
today the tribunal wey dey check election wey dem do for National Assembly
people dem for Kwara State on March 28, 2015 weda e get mago mago abi dem do
abracadabra, go knack us the correct thing wey happen as e take concern oga
pata pata for Senate, Dr. Bukola Saraki.
One man wey dem dey call Alhaji Abdulrahman Abdulrasaq
, wey na him the Peoples Democratic Party (PDP) carry as dia person to take challenge Saraki for the election wey dem do, talk say sam, him no gree say no be him win.
According to the tori wey we hear, Abdulrasaq talk say na him the people wey gofment put gidigba for ground to dey do election, wey dem dey call Independent National Electoral Commission, INEC, suppose to carry him hand up, show everybody sa na him win.
As the matter pain am reach, Abdulrasaq come go report Saraki for the tribunal so dat dem go fit comot am from the seat, come put am for dia.
The tribunal, wey na three wise men dem, wey sabi, wey no dey look Uche face before dem yarn truth as e take shele, come talk say as dem don hear the PDP man matter, come follow hear oga Senate presido own, dem don reason am say kai, we must to settle dis case today.
The pesin wey go come talk am as e be inside the three men dem wey sabi, na Justice Josiah Majebi.
Na
the tori be dat oo! Una well done.

0 comments:
Post a Comment