Monday, 12 October 2015

Presido Buhari Don Send New Names Of People Wey Go Become Minister To Senate

By on 11:23


The second batch of people wey go follow oga Presido Muhammadu Buhari work wey dem dey call ministerial nominees, don reach Senate Presido, Bukola Saraki hand. 

The first batch, wey oga presido send go give Saraki for the last day of the month wey we just pass so, been get the names of 21 ogbonge people including the governors wey
just hand over for Lagos, Ekiti and Rivers State – Babatunde Fashola, Kayode Fayemi and Rotimi Amaechi plus the oga wey dey help APC talk, Lai Mohammed and the rest dem.

Senate Presido Saraki on Monday, been collect the new names from oga Buhari right hand man, Abba Kyari and person wey dey help oga presido pata pata to know wetin dey happen for Senate, Ita Enang. 

E be like say from wetin we dey hear, na 15 names oga Buhari send go give Senate.

As we dey wait, dey stretch our neck to see the new names wey oga Buhari don send today, make we remember say tomorrow na the day wen Senate dem go do exam for the first batch ministers dem. 

Na him be say na on Tuesday we go know weda Fashola, Amaechi, Fayemi, Mohammed and the remaining 17 people wey oga Buhari been choose, go pass the tough exam wey our lawmakers don set for dem.

Na the tori be dat for today ooo!

0 comments:

Post a Comment